‘I neva sabi woman and I no dey do arrangee miracle’ – Zion Prophet Ebuka Obi

Start
3 months ago

Popular preacher for Nigeria, Prophet Ebuka Obi don deny allegations of fake miracle wey pipo dey accuse am of for im church, Zion Prayer Movement.

Di man of God get massive following for Lagos State, Nigeria commericial centre.

E also get pipo wey dey worship for im church across southern Nigeria. E tok say im no know wetin pipo dem call ‘arrangee miracle’ and im neva do am bifor.

“All di pipo wey tok about ‘arrange miracle’ don show say na wetin dem sabi bicos na pesin wey be fake go fit identify wetin be fake easily,” e tok for inside one interview wit BBC Igbo.

“Wetin dey happun be say di pipo neva see anytin like dat bifor, dem neva see unique annointing like Zion Ministry wia prophecy dey come wit instant solution.”

Nigeria na very religious kontri wey dey almost evenly divided among Christians and Muslims.

Preachers for Nigeria dey among di most popular and most wealthy for di world and dem dey command enormous respect among dia followers.

Allegations of fake miracles by some Christian clerics no be new tin for di kontri.

Di BBC Africa Eye bin do one investigation wia followers of one ogbonge preacher Prophet T.B Joshua tok say di man bin dey use dem to arrange fake miracles.

But Ebuka Obi throw challenge say “anybody wey say we don use am to perform fake miracle, make di pesin come out openly and tok am”.

‘I still be virgin’

Di prophet also tok about why im neva marry and why e still be virgin reach now.

“I neva date or sleep wit woman bifor, any woman wey say I don sleep wit am, make e come out and tok am,” Obi tok.

“E no be like say I dey look for any specific quality of woman to marry, if na by like dat e no get any quality of woman wey I neva see.

“Wetin dey hold me be say I wan hear from God make I get direction, and im neva direct me on anytin about marriage. I don pray tire but I neva get any slightest sign about who or when to marry.”

Oga Ebuka Obi also address im constant wahala wit di Catholic Church wia im bin belong to bifor e set up im own ministry.

Tori be say di Catholic Bishop of Lagos Archdiocese, Adewale Martins bin direct all Catholic church members make dem stop to dey go to Zion Ministry for prayers sake of wetin im refer to as di “disobedience” of dia leader.

But Ebuka Obi tok say im neva comot for di Catholic Church no matter di wahala wey e dey get wit di leadership of di church for Nigeria.

“I still be member of di Catholic Church, I still dey go for confession, I still dey receive Holy Communion till today. Na di late Bishop (Gregory) Ochiagha of Orlu Diocese do me confirmation, so I no go comot go anywia, di vow I bin take (for di Catholic Church) I go keep am till i die,” e tok.

WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com

Don't Miss

Busta Rhymes charged with assaulting staff who was on the phone during work

The famous rapper is being charged for beating up one of his

Three Nigerian Women released after 10-month in saudi jail .

THREE Nigerian women, who were arrested and prosecuted for drug trafficking in