
Failing business, rotten food and too much money to buy fuel. Dis na wetin Nigerians dey endure sake of poor power supply.
Even say power wahala no be new tin for Nigeria, dis year alone, national grid don collapse 10 times since January.
Dis make am one of di worst situations wey Nigeria don experience for many years.
On Tuesday, Nigerians face anoda blackout again becos di national power grid collapse.
For October alone, di grid fail three times witin one week, e cause blackout eviri wia and e make Nigerians react.
For 10 days more dan a third of di kontri 36 states bin dey darkness sake of a major fault for di transmission grid.
Ms Chidinma Emeneka na one of millions wey di collapse of grid dey affect on a regular – and now she dey struggle to keep her business.
Di 27-year-old tell di BBC say her company gatz begin rely on generators wey don cost to keep going afta she dey wit out light for about six weeks.
“My meter dey bad, di platform to apply for a new meter dey down, no way to get a new meter and no way to get light.”
Dis time di entire neighbourhood no even get light for up to one week sake of di collapse of national grid.
Di situation bin worse for Northern Nigeria wey no see light for many days.
Businesses like frozen-food vendors lost thousands of dollars – dem throway di frozen food dem including frozen fish, chicken and turkey wey don dey rotten.
Wetin be di reason for power wahala for Nigeria?
Many experts dey believe say old equipment, small capacity, and poor maintenance dey affect di power network, make light dey lose for transmission.
Heather Onoah, wey dey for GENCOs Board of Trustees explain say lack of transmission facilities na one of di main problems wey dey cause grid collapse.
“We no get enof transmission facilities, or network wey go carry dis power go wia dem go use am,” she tok.
“So, sometimes power go even dey flow back into di system, make everytin scatter.”
To end power wahala for Nigeria, experts tok say Nigeria need to upgrade and repair some parts of di power system and begin use modern methods, especially like solar energy and other alternative dat fit be sources to supply power.
One expert, John Adebayo, electrical engineer, tok say e dey important to explore different ways wey fit help improve light for Nigeria.
“Di lasting solution for Nigeria na sustainable, fit even expand reach oda countries.”
E add say, “Power solution dey simple, make we use hybrid style, repair all di bad equipment on di path wey carry light reach consumers, and make hybrid dey.”
Anoda expert wey chook mouth for di mata, Victoria Ibrahim, wey sabi renewable energy, tell BBC say if Nigeria use solar or hydro power wia e fit work, e go change di electricity wahala for di country.
“If we try tins like decentralization, use renewable energy from waste, small hydro or solar wia e fit work,” she tok.
She add say, “Na some of dis methods fit bring us di reliable and steady power we need for Nigeria.”