
Di Prime Minister if India, Narendra Modi, go visit Nigeria on November 16 to 17, 2024, as part of im three-nation diplomatic tour wey go also include visits to Brazil and Guyana.
Dis go be di first visit of an Indian head of state to Nigeria in 17 years afta di visit of former Prime Minister Manmohan Singh in October 2007.
However, Modi na di fourth Indian Prime Minister wey go visit Nigeria.
Di first na PM Jawaharlal Nehru for September 1962, followed by PM Atal Bihari Vajpayee for December 2003, and PM Manmohan Singh for October 2007.
Dis visit na on di invitation of President Bola Ahmed Tinubu.
During di visit, Prime Minister Modi go hold tok-tok (wit President Tinubu) to review di strategic partnership between India and Nigeria and discuss further avenues to improve di bilateral relationship,” one statement by India ministry of external affairs tok.
PM Modi go also address a meeting of di Indian community for Nigeria.
From Nigeria, Modi go head to Brazil for di G20 Summit wey go happun for Rio De Janeiro from November 18-19.
President Tinubu bin don visit India and meet wit PM Modi during di G20 Leaders’ Summit wey hold for New Delhi in September 2023.
For dat meeting, dem bin discuss how to strengthen di relationship between di two kontris especially for areas of trade and investment and capacity building.
India and Nigeria get very robust bilateral relationship as India dey for di top five kontris of trade wit Nigeria both in export and import.
According to di National Bureau of Statistics, Nigeria’s second largest export for di fourth quarter of 2023 na to India wit 8.68% of total exports within di period. And for imports, India na di fourth kontri wit 6.44%.
Also, more dan 200 Indian companies don invest ova $27 billion for different sectors for di Nigerian economy, according to di Ministry of External Affairs of India.
India get an estimated population of more dan 50,000 citizens for Nigeria and dis represent di largest Inidan expatriate community for West Africa, according to di Indian High Commission in Nigeria.